
Below is the lyrics of the song Yankula Ya , artist - Timaya with translation
Original text with translation
Timaya
I say they done come
Nothing we do them
Nigeria na my country oh
Bayelsa na my state oh
This na reality
Well e bin happen for Bayelsa oh
Nineteen Ninety nine oh
I swear I no go forget am oh
When them kill the people oh
And they make the children them orphans oh
Any time wey I think am oh
Water dey pour from my eyes oh
Somebody say make I leave am oh
But I say me I must talk am oh
I say them don kill them mama eh
Them don kill them papa eh
I say them don kill them mama
Them papa them mama them papa them mama eh
I say they done kill them mama eh them papa eh ah
Them mama eh ah
Wetin we go do iyo
Do iyo
Say do iyo
Na so them march dey go iyo
Ten thousand soldiers for road iyo
Ask them where them dey go
Them say them dey go Bayelsa oh
Which place for Bayelsa
One village they call Odi oh
Na im them enter our village
And rape our young girls
And make us homeless oh
Them kill our mama iyo
Them kill our ppaa iyo
Them kill our brothers
Them kill our sisters
And make us homeless oh
Wetin we go do iyo
Do iyo
Say do iyo
Everybody dey cry oh
I say Government them bad oh
REPEAT CHORUS
I don die oh
Poverty no good at all oh
Everyday for Nigeria
Na so the people them dey die oh
Eeeehhh, our government oh
Na why una make us dey cry oh
OOooh, everyday for Nigeria
Na so the people dem dey die oh
Them commot for house for morning oh
Money no dey for your hand oh
Police go stop you for road
Them go collect the one wey you get oh
Them lay allegation for your head oh
For wetin you no do iyo
Before you go know
My brother, you don dey inside cell oh
Timaya • 2022
Timaya, Sayo Pisanta • 2018
Timaya, Wrecoba, Allenian & TJ 2 Solo • 2018
Timaya • 2019
Timaya, M.IDe Rebirth • 2018
Timaya • 2019
Timaya • 2016
Timaya • 2018
Timaya • 2018
Angela Maria • 1956
Ece Seçkin • 2024
Eloy • 1992
Jam in the Van, Trash Panda • 2023
Reinaldo • 2002
Çeşitli Sanatçılar, Alp Arslan, Faruk Salgar • 2012
I$$A • 2020
Songs in different languages
High-quality translations into all languages
Find the texts you need in seconds