Power Show - Fela Kuti

Power Show - Fela Kuti

  • Year of release: 2009
  • Language: English
  • Duration: 14:48

Below is the lyrics of the song Power Show , artist - Fela Kuti with translation

Lyrics " Power Show "

Original text with translation

Power Show

Fela Kuti

Everywhere you go

Everywhere you dey

Everybody want do power show

Na wrong show O

You reach boarder immigration

Officer dey

Him go bluff you

Waste your time

Change him pants

Some dey comb dem hair

Den tidy dem table

Den dem pull dem chair

Before him go know say you dey there

If you no talk quick

Him go go for shit

Him go shit come-back

And you talk to am

Then you suprise when him

Shack for you

Him go say you no go cross

You no go cross today

Na that time dem go start Dem

Power Show O O

Na wrong show

Go post office na the same

Dem go bluff you

Waste your time

Run you up

And then run you down

Dem go tire your body

And then tire your mind

And them tire your whole mind

Dem go say no change for fifty Kobo

Na that time dem go start them

Power Show O O

Na wrong show O

Motor car owner sef him go take

Him car push him car push laborer

Down for road

Then him start to yab

Foolish labourer

Nonentity, him no get money

Look him sandals e don tear finish

Look him trouser e don tear for yansh

Look him singlet e don dirty finish

Look him body e no bath this morning

Look him pocket e don dry finish

You go suffer for nothing

You go suffer for nothing

You no know me sha?

I be General for Army Office I

I be Officer for Police Station

I be secretary for government office

You foolish laborer, Nonentity

You go suffer for nothing

Na that time dem go start dem

Power Show

Na wrong show O

Power Show

Na sad thing

Na bad thing

Na wrong show O

Power na to help your land

Na to help your mates

Na wrong show O

Other songs by the artist:

New texts and translations on the site:

2+ million lyrics

Songs in different languages

Translations

High-quality translations into all languages

Quick search

Find the texts you need in seconds