Iya Basira - Styl-Plus

Iya Basira - Styl-Plus

  • Year of release: 2005
  • Language: English
  • Duration: 5:14

Below is the lyrics of the song Iya Basira , artist - Styl-Plus with translation

Lyrics " Iya Basira "

Original text with translation

Iya Basira

Styl-Plus

This na one buka wey I dey like to go

The food sweet sote e go make your mind blow, day and night iya bas how she do

am I no know

They think say na jazz, my broad no be so

People people make una come o

Iya basira e don jazz me o, ooo

Everybody helep save me o

I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place

People People make una come o

Iya basira e go kill me o, ooo

Everybody helep save me o

I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food

Long throat na food go kill you-no be so, I say na food go kill you — oga mi no

be so

Wettin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday

Na so I reach there but Sunday e don high on beer luckily for me him junior

broad eye e clear

He say make we stroll to the area, little did I knw that I was strolling to my

burial

Right there were oshodi bus dey load was a little buka close to the mainroad

I laf when e pass the door, e tell me say hin name na Iya bas for short but I

bow when e order

Iwesiatewa, ero mm purewater not even mineral.

I come gree say I go manage to

chop am

Before I realize I dey order 2nd round, 3rd round, 4th round, I never still stop

Wetting iya basira e give me chop?

Repeat chorus

Long throat, na food go kill you, na food go kill you

Oga mi, you think say na play when I say na the way wey I dey, e no day ok

Wetting be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy iya basira

rice

Even on my girlfriend birthday when she dey wait make I take am to ocean view

I no know when I pass the place, the only thing wey dey my mind na Iya basira

palm oil stew

Ah!

Kilon kilon shele shele me I never see this kind juju, telle telle

All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya basira na…

I sure say still I go go there go sidon, order my first round move

To 2nd round, 3rd round 4th round I no dey ever stop wetting iya basira come

give me chop?

Repeat chorus

Officer abeggi follow me to the palce, everybody don telli me I dey craze

My girlfriend don leave me my moda no gree see me my paddy ah!

Iya basira e don

kill me.

(x2)

Oya people, people make una stop officer e don come

Where the woman, hin dey inside, (oga I dey come)

Woman na wetting you dey give people chop wey dey cause all this wahala casala,

oya make we talk

Oga sir true to God, nothing wey I dey put for the food wey I dey cook,

na God dey make am good

Na which kind talk be that, say na God dey cook the food abi you think say I be

fool no be juju you dey put

Infact I dey suspect say na… You wash put sote people dey queue come dey

rush for your stew

Well to confirm am bring am make I chop small.

Give me fufu 90 naira plus that

soup wey dey draw

Chaii correct this food sweet no be small shey una no go vex if I still order

for more

Officer no worry na the food be this

Oya people, people make una go, case dismiss

Repeat chorus 2 times

Other songs by the artist:

New texts and translations on the site:

2+ million lyrics

Songs in different languages

Translations

High-quality translations into all languages

Quick search

Find the texts you need in seconds